Hello our pipo. Una welcome to our blog again o. Wetin dey give you joy pass for dis life? The thing na the kind thing wey go make other people laugh you?
Abeg my brothers and sisters, make you no use because of say somebody go laugh you, take leave wetin dey totori your body and soul.
This life sweet well well o, but before you go enjoy am well sef, you go learn how to dey ignore so many things wey no dey add better thing for your life.