My Favourite Authors : Nigerian Edition

Screenshot_20200704-210357.png
Image by @mistakili

Hello Naija. How una dey? So today I wan talk about my favourite hive content creators from Nigeria. My pidgin no too strong but I say make I challenge myself. No laugh me abeg, na pidgin I dey try write, I no kill person.

Since I join hive e get many Nigerians wey dey burst my brain with them post. I go just mention some few ones but if I no mention you, no reason am, all of Una dey try. Chei God, I dey feel this broken. Anyway, base on logistics, make I start.

@maxwellmarcusart

Guy, Picasso and Da Vinci abi wetin be their name dey learn work for where you dey. The first time I see the bros art work I first think say na jagajaga but as I look am well, guy you tight. I say make I join e daily drawing challenge one day, na then I realize say to draw jagajaga sef na strong skill. I just kpomkpi.

@mattsanthonyit

This na one of the accounts wey dey give me joy because I dey learn one or two from him posts. All the farm and agriculture content dey really make me consider going into agriculture. This Oga na family man wey get love for his family. Check am out for all things agriculture.

@uche-nna

If you like books, especially story book, then you go like this guy. He dey give suggestions on books to read and any book he suggest, just take am like that, no think am twice. All him book reviews dem tight, you go like read am even if you be coconut head wey no too like book like that.

@ebingo

I like this guy because he dey write poetry and story wey dey make me ask questions. If you read him write-ups you dey feel the passion. He get rhymes wey dey burst brain, you go like check am out for some word play.

I go like continue but I Don tire, to write for pidgin hard pass speaking. If you think say na lie comment only in pidgin.

So this is my entry for this week's @hive-naija challenge.

H2
H3
H4
3 columns
2 columns
1 column
Join the conversation now