Hive naija contest- I LIKE MYSELF

HIVE NAIJA CONTEST

My gud pple, I troway salute o,abeg no vex en today,me I no go only talk for pidgin buh I go folo try write for pidgin, so e mean say make u take ur body take join wid ur mind try read am well.

Dis post,na for d oda contest wey bin finish yesterday I bin write am buh d thing no been free publish na him DAT one past me,so make I just still send am for dis other one,buh as for secondary school tori,just jeje waka com again u go see am

As I bin don talk before for my introduction wey dey @sirmartinet,my real name na Martinet- Joshua john, I dey like advice pple make dem no ask me wetting sup for the dash wey dey my name bcos even me self dey confuse for DAT same matta.

Anyway, me I no tall oo,I take style short small buh make e be say I dey try console myself, I d like tell pple say I dey average, even me self I no kno wetting e mean wen doctors d tell person say him height na average,
I hope say any doctor for here go try explain DAT one for d comment box,

See ehn! No be like say I be ameabo oo,but make I use my mouth talk dis one,
I like short pple,I dey here as girls for school d talk say
"Ehn me I want guy wey be 6ft tall (I wander weda dey wan guy wey dem go use measure grave yard)
For my mind I dey ask,na who go marry dose short ones wey dey there?

See ehn,me I like as I dey short o,

Make I tell u something wey been happen for school

I know say na only Nigerians wey fit read wetting I dey write so anybody wey no fit read pidgin,him no go hear wetting I want talk

Ehn ehn! As I been d talk,e get one day wey for last semester before dis sista co co (covid-19) come,we just dey on our own o,hunger d wire student for skull, e plenty wey never pay school fee,so management come d find way wey dem go do make students dem pay,u kno say dem no d pursue for school fee na like secondary skul
So dem come comot one big grammar come say na management test,we say kwa?

Which one be management test nii?

U sabi students na,dem come d prove strong head say dem no go write,
My dear,to cut d long story short,na him students dem protest,lock skull gate ,no grew make any lecturer come in,no lecturer even commot outside,

Instead make provost come see him student, him com send police, na him students ransack police men, burn their car, so na army been later come,

My dear, if u see aw pple been d run,na ther I thank god say I short o,becos I been d see my fellow short men even run pass me,
U go see as croud dey
And army d flog pple,bros na to waka between person leg oo if na wetting go save u from beating be DAT.

I been talk say I no be amaebo so If u talk make my departmental president hear am,no mention my name oo cos d guy tall and him been collect some flogging sha.

Oook make I use dis time take cut twalle for my elder bro wey I don't senior bros @mistakilli and the other guy wey I never see but I feel say him tall pass me @balemo

One thing wey I no like short pple be say dem to d do like say dem one forget something, no be like say dem forget o

E just dey like now,shortness for do make I forget my elder senior broad @tomlee, I no know why him choose DAT name but me and him d fight who tall pass since day before yesterday,in fact na DAT matter wey @mhizerbee d try settle till now. @evegrace chop ur thing the go oo
No remember us ooo

Abeg no forget,my name na @sirmartinet, if u smile as u been d read dis blog,just take style upvote am and no forget to reblog oo

H2
H3
H4
3 columns
2 columns
1 column
Join the conversation now
Logo
Center