This is the Nigerian creole (Naija pidgin) translation of the original post by @good-karma.
I don bring una all the slides wey we been present yesterday for ontop steemfest stage.
eSteem Mobile 2.0
Shey una fit remember the old one wey been comot before? Dis one na the new one wey don show face. We dey expect say the alpha eSteem mobile 2 go comot dis month shaa.
I don package more ogbonge screenshots come outside of how the future eSteem mobile go dey.
eSteem Surfer 2.0
Dis one na the application wey go work on desktop. We don migrate comot from the old one enter dis new one. We don drop the eSteem Surfer 2.0 alpha come outside yesterday. Una fit download am, make una feel am wella.
Make una try feel am and confam say ein make better sense, and make una drop suggestions wey make brain join. Una fit enter the official site make una download am. Abeg make una continue to chuk eye for inside @esteemapp and @good-karma, cos tori go full ground about eSteem mobile 2.
Hivemind & SMT, Search, Community and Exchange
Na ontop Hivemind na ein we build the search for eSteem, and we don bring am come outside recently.
Dem pipu go join hands for inside the Hivemind. We don already see as we go take make am happen sef. We don pack the draft show face of how dem pipu go look like.
we dey expect say SMT go drop for inside spring of 2019, and plenty tokens go show face come outside from steem, and we go need were we go fit trade dis tokens. We go bring ogbonge exchange come outside - ein go be eSteemX.
Roadmap Wey Dey For Future
See as we go take dey drop ogbonge eSteem products. The dates fit no join body follow as we don talk, sake of say market fit change. But all go drop for our doormot the coming years.
eSteem Meetup
We don meet for here, but I go drop post wey go talk as we take relate for inside the meetup. Enuf of chop na hin we arrange for there oo.
Oya make una see dis video
All images are the property of @gook-karma
info@esteem.app
š
eSteem.app
| šØāš»GitHub
| šŗYouTube
āš»
Telegram
| š¬Discord